How women dey use mountain biking for weight loss

Wetin we call dis foto, Chaingang ladies wey dey do mountain biking for Abuja, Nigeria capitalArticle informationAuthor, Tamara EbiweiRole, Broadcast JournalistReporting from Abujaone minute wey don passSome women for Abuja, di Nigeria capital dey gada evri weekend to ride bicycle for places wey no dey smooth like good roads.Dem dey follow dia colleagues wey be men dey ride for bush paths, places wey get hills and moutains for long hours.Dis ride wey dem dey do na Mountain Biking and dem dey cova plenti kilometres sake of say dem dey ride thru communities to cova dia distances for di day.Di women say plenti benefits dey for di sport wey include weight loss, stamina, physical and mental health.Di group wey dis women dey follow ride na Chaingang and dem dey also encourage women to do mountain biking to make dia bodi dey gidigba.One of di women wey no dey gree for men at all wen e reach mountain biking na Heich Bakori wey dey in her early 30s.She dey bench some men wen e come to long distances. She fit ride a distance of 60 to 70 kilometres.She tell BBC Pidgin say since she start mountain biking she don begin do tins wey she no fit do bifor sake of say her stamina don increase.”Most of di women wey dey dis our cycling group get stamina, we get mind, my endurance and strength don increase,” she tok.She encourage oda women to try do sport like mountain biking to help dia bodi dey gidigba.Heich na young corporate public relations expert wey dey do mountain biking despite her busy schedule. She add say if she fit do am, e no dey late for oda women to start.Wetin we call dis foto, Heich Bakori bin dey struggle to climb hill wit her bicycle for Abuja, Nigeria’I dey weigh 100kg bifor, now na 70kg’ -Funke AbeyMrs Funke Abey na one of di women mountain bikers for Abuja, she be wife and mother of three children.She tell BBC News Pidgin say her family no dey stop her at all, especially as evribodi dey see di benefits of mountain biking for her bodi, especially weight loss.Funke wey dey her 40s still dey ride bicycle for fitness and oda health benefits.”Sometimes bifor my children go wake up from sleep I don scata like 30 to 40 kilometres wit my bicycle.“Bifor I join dis mountain biking I bin dey weigh almost 100 kilograms but see me today, I dey weigh 70 kilograms,” Funke tok.Bodi dey sweet her as she dey share her weight loss tori wit BBC News Pidgin.’Di men dey protect us’ – Victory OjiminiWetin we call dis foto, Victory Ugochi Ojimini wey be caterer na one of di mountain bikersSake of say dem dey mostly ride for rural communities wey get bush well well and hills, security na one of dia concerns.But Victory Ojimini wey be fashion designer and pastry chef tell BBC News Pidgin say dia security dey intact and di. women for di group dey safe.She explain say di men for di group dey protect dem well well and dem neva encounter any serious danger.”Di men for di group dey protect di women for inside bush wen we ride and e dey sweet my belle.”As we dey ride inside bush we get take security serious and na dis our men dey help protect us.For di trail, we dey carry some items sake of security, like pepper spray, small knife wey we fit use defend oursef incase of any attack.She add say dem dey also use di knife do mechanical work. In case anybodi bicycle spoil, dem fit use di knife to cut wire and tubes to repair am.’We dey always ride as a group, so if one pesin bicycle spoil or get any issue evribodi go stop, we go make sure say we repair am bifor we kontinu di ride. Victory add say na for morning dem dey always ride becos dem dey security concious.Some fotos of di mountain biking rideWetin we call dis foto, Di mountain bikers dey ride ontop small bridge for Abuja Wetin we call dis foto, Di mountain bikers dey repair pesin bike wey spoil for bush pathWetin we call dis foto, One of di security tools dem dey carry to protect diasefWetin we call dis foto, Di bikers carry dia bicycle cross small river for AbujaWetin be mountain biking?Mountain biking na sport wey don dey exist since wen dem dey ride bicycles off -road (outside di normal roads wey pipo sabi).Most times na for roads wey dey rough wit plenti gallops, hills and mountains.Dem dey also use special bicycles wey dem design for mountain biking.Apart from bicycle, you go need helmet, gloves, beta sports shoes, shades (eye glasses).Women need sport shorts or trousers wey get pads for front and back to protect dia private part, especially women wey dey go longer distances.

https://www.bbc.com/pidgin/articles/cd147w4r38go

Recommended For You